Categories: News

Seun Kuti blasts Buhari’s govt, politicians

Seun Kuti, son of late Afrobeat legend, Fela Anikulapo Kuti, has heavily criticised the current administration.

In a series of tweets on Monday afternoon, the singer expressed his sadness over policies of the President Muhammadu Buhari-led government.

Seun lamented that nothing is working in the country and that the youths are neglected.

In a message he wrote mainly in pidgin English, he wondered what the government is doing concerning the education sector.

He wrote, “So dey want us to think stupid, everybody celebrating, they have been celebrating all dis days, but who is celebrating d slavery days?

“Naija Youths ask again, Wetin b dis present Naija govt policy on Education?

“Every ruler dey talk about peace, but none of dem dey talk about Justice, no job & food 4 d poor, university don close for weeks, Youths are idle.

“Wetin happen to equal right & justice, why most Naija rich pikin dey go uni 4 oyibo land & dem go come close our own uni for our motherland.

“Wetin happen to equal right & justice, why some people go sick and go foreign land for treatment, wen poor pesin dey die 4 Naija of malaria.

“Wetin happen to equal right & justice, politricians go dey rich pass wen dem enter power & court go still find dem not guilty of corruption.

“Wetin happen to equal right&justice, poor pesin go go jail 4 stealing N100pepper 4 Mkt, politricians go waka free 4 stealing billions in govt.

“Wetin hapen 2 equal right & justice, Paedophile go rape poor pesin pikin,police go settle out of court like notin happen, rich pesin fit gree?

“Wen we no sabi our govt policies on many things, how we go sabi our right ? My people ask for your govt policies.

“We d people need to start to dey ask our politricians for figures, e.g., “if u say u wan build road, oga where u go get d money?

“We Naija people need 2 stop 2 dey accept injustice from govt, Na bcus of us Govt dey, no b we dey bcus of Govt

“I hear say Govt Na our papa & we b d pikin, if Govt b our papa, Se Govt suppose to dey let us(im pikin) suffer like dis?

“That’s why I open my mouth I sing ‘For Dem Eye’ “we no important for dem eye”, bcus if we important, uni no fit close make Govt no fit yarn.

“If we important ‘for dem eye’ poverty no fit dey contri like dis make dem never find solution, while dem dey live rich in their big houses & yatch

“I ask again after all dis yarn, “Se our Naija Rulers dem like us or dem like demsefs?”

Leave a comment

247ng

Recent Posts

Boko Haram, ISWAP change tactics in North-East

Terrorist groups now use armed drones to attack military facilities The new Chief of Defence, General…

8 months ago

US troops may enter Nigeria to wipe out terrorists killing Christians, Trump says

The US President, Donald Trump, says he’s ordered the Pentagon to prepare for possible action…

8 months ago

BREAKING NEWS: Mangrove Marathon 10KM Warm-Up Race: RUN FOR THE COAST — RUN FOR A SAFER FUTURE! REGISTER NOW

It’s more than a race — it’s a movement to protect the coasts that protect…

8 months ago

Rivers Residents Stock Up, Travel Ahead of Saturday’s LG Election

Port Harcourt was a hive of activity on Friday as residents crowded major markets and…

10 months ago

Not Just a Stay — An Experience! LAUREL BLUE SUITES

✨ Not Just a Stay — An Experience! Welcome to Laurel Blue Suites — Your…

11 months ago